fbpx
May 18, 2024

Di hatred for me dey too much – Desmond Elliot don cry out

di-hatred-for-me-dey-too-much-Desmond-Elliot-don-cry-out

Nollywood actor wey turn politician Desmond Elliot don cry out over di hatred wey hin receive from pipo for di comment wey hin make in 2020.

Desmond elliot

FOR MORE NEWS: Disappointed – Ronaldo react as Al-Nassr lose to Al Ittihad

You go remember say in 2020 during di #ENDSARS protest, Desmond Elliot receive heavy backlash after one video of am as hin dey tok during plenary session of di Lagos state House of Assembly see am refer to Nigerian youths as children.

Dis comment no sit well with most Nigerian youth wey don dey drag am since di incident for 2020, Although Desmond Elliot apologize for di comment wey hin make. As di matter be so, e be like say di past don come back to haunt am.

During recent interview on Your View, “Let’s Talk”, hin apologize again. Hin yarn say he make di comment on emotions.

Also, Desmond Elliot cry out say di hatred wey hin dey receive from pipo dey too much. He open up say anytime wey hin enter street, hin dey always receive verbally attack everytime from pipo.

You fit go see di full gist…READ MORE