fbpx
May 5, 2024

“To say ‘sorry’ for abroad fit put you for trouble” – UK-based Nigerian lady reveal

uk-based-nigerian-lady-narrate-sorry-experience

One UK-based Nigerian lady narrate how she almost enter wahala because she dey always say ‘sorry’ for everything. Di UK-based Nigerian lady wey dey known as progressoberiko narrate one of her experience of cultural shock wey she experience overseas.

She narrate how she go buy product wey no dey sealed. As she dey tok di tori, she yarn say na as she reach house she discover say she get another one. Dat one kon make her decide to return di product back to di shop where she buy am.

When she return am to di shop, di receptionist bin dey write some kain thing inside computer, na so di Nigerian lady tok ‘I’m sorry for any inconveniences’.

 

FOR MORE NEWS: “You Fit make 4 million per month” – Hilda Baci share tips

 

She reveal say dat statement make di receptionist pause. Di receptionist kon need to ask di Nigerian lady again weda na true she tok say she no use di product.

Also, di sorry wey di Nigerian lady tok make di receptionist dey wonder why she dey sy ‘sorry’ if she neva use am.

Na dis experience na hin make di Nigerian lady dey advise compatriots ,ake dem no dey quickly say sorry every time as dat one go make di matter be like say dem dey guilty of something.

You fit go read di tori see netizens reaction on di matter of di sorry experience wey di UK-based Nigerian lady narrate…READ MORE