fbpx
May 5, 2024

Mixed reactions as Portable perform for Nigerian Bar Association conference party

portable-perform-for-nba

Di invitation of Nigerian singer, Portable, to perform for di Nigerian Bar Association, NBA conference party for Abuja don spark mixed reactions.

Portable, wey pipo know for hin strange and controversial lifestyle, show up without shirt for di party and hin deliver electrifying performance for di event.

Just as pipo expect, di Zazu star perform hin hit songs with energetic and hin even climb a scaffold wey dem set up inside di conference venue, as hin dey dance.

 

FOR MORE NEWS: Actor Bolanle Ninalowo don announce di end of hin marriage to wife, Bunmi

 

Dis matter don spark mixed reactions on top social media, and plenty dey question NBA choice to invite Portable as dia guest musician.

Even as some pipo dey hail di organizers for di choice, others yarn say Portable no be musician wey dem for call for di conference of ‘learned fellows’ perform for NBA.

Some others argue say someone like Falz, wey be lawyer himself, for better as guest artiste.

 

You fit go read di tori…READ MORE