fbpx
May 9, 2024

Students go undertake drug test before admission — UniAbuja

uniabuja-students-must-present-drug-test

Vice Chancellor, University of Abuja, UniAbuja Prof. Abdul-Rasheed Na’allah reveal say students wey plan to study for di university must undertake and present drug test before admission.

Na’allah, wey tok dis matter for di 27th Pre- Convocation briefing for Abuja on Wednesday, yarn say di institution dey work with NDLEA to help students wey dey involved in drug abuse and to rehabilitate dem.

Also, hin yarn say drug status of students dey important in order to help students make dem dey free from drugs.

Though he yarn say dem no go send di students out from school if dem dey involved in drug abuse, but dem go try rehabilitate di students in collaboration with di NDLEA.

Also, di vice chancellor reveal say 7,128 undergraduate students go graduate for di school convocation wey go hold on Saturday, October 7.

 

FOR MORE NEWS: Mohbad: Court don remand Naira Marley, Sam Larry, and 2 others

 

In addition, hin list out di pipo wey go graduate, 100 PhDs, 326 academic Masters and 346 Professional Masters.

Hin yarn say 40 students go graduate with First Class, 474 with Second Class Upper, 944 Second Class Lower, 174 with 3rd Class and One Pass degree.

However, hin tok say di university don ban Pass degree going forward.

Also, di vice chancellor explain say di institution go introducing Russia Language as part of di general courses wey students must pass before graduating.

You don read di tori, UniAbuja students must present drug test now….You fit go…READ MORE