fbpx
May 18, 2024

CBN Go Ban Dollar Charges On Card Transactions

gbajabiamila-sign-warrant-arrest-againt-Emefiele

Di Nigerian Interbank Settlement System (NIBSS) with di Central Bank of Nigeria (CBN), don launch di Nigerian National Domestic Card Scheme wey dem name, AfriGo. Dem create di card so that dem go get more robust payments system wey go drive financial inclusion for di country. Following this development, CBN go ban dollar charges on card transactions.

This move on Thursday, January 26, by di apex bank na part of efforts to reshape di country payment structure. As Emefiele dey launch di card virtually,  hin add say di apex bank CBN go ban payment of charges (in dollar) on card transactions within di country for di next few weeks.

FOR MORE NEWS: NASS and CBN dey drag over old naira notes deadline

Di domestic card scheme dey expected to strengthen di  national payments system and to deepen di usage of electronic platforms for Nigeria.

Now wey di foreign exchange challenges still continue globally, hin tok say e dey important for dem to  come up with di card so that all card online transaction go dey effective and immediately enter di Nigerian domestic card system.

 

You fit go read di full tori…READ MORE