fbpx
May 5, 2024

Transfer: PSG don remove Mbappe from website cover

PSG-remove-Mbappe-from-website-cover

Paris Saint-Germain, PSG don remove forward, Kylian Mbappe from dia website cover with di France captain wey dey linked with di move to Real Madrid for di ongoing summer transfer window.

Pipo like Neymar, Lee Kang-In, Marquinhos, Lucas Hernandez, and Marco Verratti na di current players wey dey on top PSG cover.

Mbappe no dey part of di PSG squad wey dey tour Japan and South Korea as part of dia pre-season.

Earlier dis summer, Mbappe tell PSG say hin no go extend hin contract beyond di 2023-2024 season.

 

FOR MORE NEWS: Uko don quit Shooting Stars after two years

 

As a result, di Parisians dey find way to sell di 24-year-old dis summer sai dat dem no go lose am om free transfer next season.

Mbappe dey linked with a move to Real Madrid and hin don dey train with PSG team to keep himself fit.

However, PSG latest decision to remove Mbappe from dia website cover fit dey show say dia all-time leading goalscorer go soon comot from di French Ligue 1 champions dis summer.

You fit go read di tori…READ MORE