fbpx
May 5, 2024

Chelsea don sign France defender Disasi from Monaco

chelsea-sign-french-defender-

Chelsea announce on Friday say dem don sign French international defender Axel Disasi from Monaco for six-year contract.

Di centre-back, wey don make 130 appearances for Ligue 1, don play for di team four times and hin bin dey part of dia squad for last year World Cup.

Co-sporting directors Laurence Stewart and Paul Winstanley yarn say Axel don showcase hin quality over several seasons for France and dat one don lead to di recognition on di international stage.

 

FOR MORE NEWS: Tenure limit: Finance ministry order senior directors make dem resign

 

New Blues manager Mauricio Pochettino dey try change hin squad following di club worst Premier League season for almost 30 years

However, di 25-year-old yarn say hin dey happy to join di club, and hin dey proud to be part of di great family. Also, hin yarn say hin hope to achieve very big things for di club and to win titles.

In addition, hin tok say hin go do everything  wey hin fit do to achieve those objectives. And hin no fit wait to feel di energy of di fans.

As Chelsea sign French defender, you fit go read di tori …READ MORE