fbpx
April 25, 2024

Qatar2022: Portugal no fit stop Morocco to reach Semi final – Regragui

0

Morocco coach, Regragui don come out tok say him get believe say hin team”Atlas Lions” go beat Portugal for dia Quarter-final game in di ongoing Qatar 2022 FIFA World Cup.

Di Atlas Lions go play Portugal on Saturday, December 10 (today) for Al Thumama Stadium inside qatat.

U FIT ALSO READ Qatar 2022: Argentina beat Netherlands On Penalties, con enter Semi-Final

Regragui yarn dis one during hin pre-match news conference.hin tok say Morocco dey focus on dis match.

Hin tok say all di match wey dem go play dey very important to dem becos firstly dem dey play for di pipol of Morocco and at di same time dem dey try unite di pipol of Morocco.

Hin tok say ever di competition don start na so so big team dem dey play and e don master bodi. but hin team at di same time need to focus well well as di match dey go.

To qualify for di Quarter-finals, Morocco beat Spain 3-0 on penalties after dem bin end 120 minutes with 0-0 for Education City Stadium on December 6.

Di Atlas Lions of Morocco dey look forward to make history as di first African nation to reach di Semi-finals of FIFA World Cup. previously dem get to di Round of 16 for Mexico ’86 but dey lost 1-0 to West Germany.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *