fbpx
May 4, 2024

“Shame on you, I’m deleting all your songs” – Gifty Powers drag Rema

reality-tv-star-drag-rema

Reality TV star, don take to social media to drag popular Nigerian musician Rema after music concert for Ethiopia bin dey cancelled.

Remember say di Sheraton Hotel for Addis Ababa release official statement about di cancellation of Rema Ethiopian New Year Eve Concert, wey bin dey originally planned for September 9.

Di decision to cancel di show happen because of di controversy wey surround di allegations of “devil-worshipping”wey dey associated with di artwork wey hin featured on top hin custom necklace.

No be secret say Rema dey wear necklace wey features di image of burning church and inverted crosses. Also, hin use di same image as a backdrop for hin album cover and performances.

Dis na wetin Ethiopians perceive as disrespectful and offensive, and di matter spark considerable public outcry and condemnation.

In addition, di Ethiopian Orthodox Tewahedo Church, wey dey deeply rooted in cultural heritage and firm religious beliefs, follow express strong disapproval of these symbols.

 

FOR MORE NEWS: Sexual harassment: UNIZIK don start installation of CCTV cameras

 

Also, because of di pressure, di Sheraton Hotel for Addis Ababa kon dey forced to cancel di event.

After di incident, ex-Big Brother Naija contestant Gifty Powers make public accusation against Rema, she claim say hin music and pictures promoted satanism.

Also, as di Reality TV star drag Rema, she reveal say she don do her own research and she discover say Rema dey promote satanic themes for hin works of art.

Na wetin she write be dis,

“To Rema, shame on you. I couldn’t believe it until researched it myself and found out REMA wore a necklace with a burned church turned upside down, like

 

You fit go read di tori…READ MORE