fbpx
May 9, 2024

Sexual harassment: UNIZIK don start installation of CCTV cameras

unizik-don-start-cctv-installation

Di management of Nnamdi Azikiwe University, Awka, UNIZIK don start di installation of Closed-Circuit Television cameras, CCTV for di institution over di allegations of sexual harassment.

According to report, dem go install di equipment for different offices of lecturers and other strategic locations for di campus.

Di rising cases of sexual harassment for di school na hin make di school management decide to find way to stop some of di matter on sexual harassment wey dey happen for di school.

Also, a tour of di school on Monday, reveal say di installation don start for di Faculty of Law.

 

FOR MORE NEWS: UAE don lift visa ban on Nigeria as Emirates, Etihad airlines resume flight operations

 

Some weeks ago, di management of di university announced di removal of some lecturers wey dey charged in di sexual harassment saga from dia respective positions while some dey suspended.

Di Vice Chancellor of di University, Prof. Charles Esimone, remove one lecturer (name withheld) from di Faculty of Law, and others wey dey accused of sexual harassment by di students of di university.

As di matter be so, di institution take di decision after di affected female students raise di alarm.

UNIZIK don start CCTV installation, You fit go read di tori…READ MORE