fbpx
April 19, 2024

Ronaldo don deny Saudi Arabia transfer deal, reject new offer from Australia

0

Cristiano Ronaldo don come out deny di rumour wey dey circulate social media say hin wan move to Saudi Arabian Al-Nassr on beta offer wey worth £173million per year.

Di Portuguese star, yarn dis one after Portugal win 6-1 against Switzerland, say all those rumour na lie ooo.

U FIT ALSO READ World Cup: Your career don dey near hin end, 3 managers no fit dey wrong – Neville dey tell Ronaldo

Ronaldo na free agent after reaching di mutual agreement with Manchester United to terminate hin contract according to hin interview with journalist, Piers Morgan.

According to tori we hear say ronaldo bin dey interested to sign new deal with different clubs like Al-Nassr whoch go make di 37-year-old forward go show hin talent for Middle East.

Ronaldo tok say all those social media tok na big lie ooo.di five-time Ballon d’Or don reject move to join one club for Australia (A-League).

One League chief way hin name bi Danny Townsend tok say him bi dey plan to lure Ronaldo to Australia shortly after di 37-year-old’s Manchester United exit but di Portugal captain don turn down hin offer.

Danny tell tori pipol say him and ronaldo don sit down discuss di mattar well well and hin see say Ronaldo bin get interest but hin no con know why e get change of plan.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *