fbpx
April 26, 2024

Sport Festival: Heavy blow don kpai one Imo State boxer for Asaba

0

One Boxer wey hin name na Chukwuemeka Igboanugo don change address go yonder for the ongoing National Sports Festival in Asaba, Delta State on Tuesday.

Chukwemeka Igboanugo, dey represent Imo State for di sport festival wey dey happun as we dey talk so for Asaba. Igbaonugo dey ring dey fight Anambra Gaby Amagor in one 86kg category bout , na during the fight he carry head collect blow from Gaby na so  he collapse for ground ontop ring.

U FIT ALSO READ FIFA dey beg Qatar World Cup participants make dem ‘focus on football’

As di referee see say di matter don dey get as e be, na so hin quickly end di match.

Dem rush Igboanugo commot for di stadium straight to hospital where dem later confirm say water don pass garri, say the boxer don kpai.

According to di State coach Endurance Aberegidi who dey the venue when di boxer from Anambra knock down Ogboanugo down, hin yarn say he dey painful say person go don use years train kon reach dis level of hin career kon kpai just like that. But I think say di medical pipol no do well at all as dem too waste time on top di matter dey look for who lost before dem rush am to hospital.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *