fbpx
May 5, 2024

I know say Benzema go leave Real Madrid for Saudi – Ronaldo tok as hin plan to own hin football club

ronaldo-own-football-club

Al-Nassr captain, Cristiano Ronaldo don yarn say hin go like to own football club for future.

Ronaldo follow yarn say hin know say Karim Benzema go leave Real Madrid for di Saudi league. In addition, hin add say several other player dey come di Middle East.

As hin dey tok on di launch of hin water brand ‘Ursu’, dem ask Ronaldo about hin plans for di future and di former Manchester United forward tok, (as per CristianoXtra).

 

FOR MORE NEWS: Super Eagles coach Peseiro dey find local players for NPL Super Six playoffs

 

Hin tok say for future, hin go like to own a club, hin no rule am out.

When dem ask am about Saudi league, di Portugal international add say hin know say Benzema dey come Saudi, and na why hin tok say di Saudi league go dey among di top 5 for di future, more players go come.

You fit go read di tori as Ronaldo tok say hin go like own football club…READ MORE