fbpx
May 2, 2024

‘Is it because I didn’t come online to beg for money?- Ronke Oshodi Oke don reveal why she lose weight

ronke-oshodi-oke-don-open-up-on-her-weight-loss-matter

Popular Yoruba actress, Ronke Oshodi Oke, don yarn say her health na di reason why she lose weight.

Di actress inside video wey she do to address trolls on top her Instagram page yarn say she dey battle with an undisclosed ailment. On top dat one, she address claims wey  yarn say she dey lose weight with ‘speedy weight loss’, a popular brand wey some number of celebrities dey endorse.

Also, di actress add say she no be fan of filter.

FOR MORE NEWS: Why I always change my mind after I decide to leave my husband, Ned Nwoko – Regina Daniels don open up

She yarn say di think wey suck her weight dey between her and God, and if she pray make her trolls dey afflicted with di thing, dem no go come out looking good like her.

Ronke Oshodi Oke don finally respond to di trolls wey don camp for her page because she lose weight. Di trolls dey use her weight loss insult her.

Di matter make di actress reveal say she no lose weight because of promoted tea or herbs, na healthwise issues wey she dey battle na hin cause am. 

Finally, she advise pipo make de dey kind.

“If i would age, it wouldn’t happen in six months.” Na wetin she tok be dat.

You fit go read di full tori…READ MORE