fbpx
April 23, 2024

Round 2 : ASUU vs FG who go win

0

Di Academic Staff Union of Universities, ASUU, don dey plan to enter another strike base on say FG no keep to dia promise

For dis month of October FG pay 18 working days salary to all di university lecturers.

U FIT ALSO READ Education na di best investment for politicians – Kwankwaso

According to tori we hear say na ‘No Work, No Pay’ policy na hin FG use against dem

Upon say Femi Gbajabiamila wen bi speaker for house of rep don settle di matter between ASUU and FG

And FG don accepts say hin go pay dem all dia salary both di time wen dem go work and di time wen dem no go work
Plenti tori don full down remain.

On Thursday members of ASUU con dey para for FG say why hin no keep to its word.

Di senior member of ASUU for University of Nigeria, Nsukka, na dem confirmed this development.

Di UNILAG branch chairperson, Dele Ashiru tok say dem don dey work on di matter say make everybody no worry

Ngige self chook mouth for di matter say many of di workers self no participate for di Union strike.

Meanwhile, ASUU don call a nationwide Congress, scheduled for Tuesday next week to decide wetin go be di next step.

To read di full tori CLICKHERE

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *