fbpx
May 18, 2024

Students dey hail Tinubu over approval to loan bill

students-hail-president-tinubu-over-loan-bill

Di All-Africa Students Union don hail President Bola Tinubu as hin sign di Student Loan Bill. Hin yarn say di scheme go be big relief to di Nigerian members and model to others.

AASU President, Osikenyi Osisiogu, yarn say Tinubu-led administration must ensure more efficient and equitable use of public expenditure by governments of Africa on education.

According to wetin hin tok, fuel subsidy thieves, Nigeria refineries’ turn-around consultants and unpatriotic modular refineries operators as well as other competitors wey dey feel threatened by di coming onstream of Dangote Refinery don collect warning make dem no incur di anger of students for di continent.

 

FOR MORE NEWS: Senate Presidency: Senators betray me – Yari

 

Also, Osisiogu hail Dangote Group for di inauguration of di 650,000 barrels per day oil refinery. Hin tok say dat one go positively impact Africa by serving as catalyst for di continent’s accelerated economic growth and development.

In addition, Osisiogu yarn say dis year African Students Day wey dem hold for Addis Ababa follow bring
promotion of children’s rights including access to education. Hin lament say about 100millions African Children no get access to Education in 2023.

You fit go read di tori as Students hail President Tinubu…READ MORE