fbpx
April 23, 2024

Singer Portable sacks all his studio staff for making only N7k in a month

0
portable-studio-matter

Controversial Nigerian singer, Portable don sack all di employees for hin studio because of di low turnover when hin no dey around

Di singer, wey dey on tour just enter Nigeria, hin announce this matter for video wey hin share for social media. For inside di video, hin explain why hin decide to sack all di staff for hin Zeh Nation studio.

YOU GO LIKE READ: 11 Home Safety Tips to Keep Your Family Safe

According to am, hin comot for di country for over a month, and on hin return, di studio staff claim say na only N7,000 dem make for hin absence.

Di Zazu zeh star and music executive claim say before hin trip, hin dey make up to N15 million from hin studio in 5 days, so e vex am am as hin studio staff report say na only made N7,000 dem make when hin comot.
Na inside Yabaleftonline this tori dey, you fit go READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *