fbpx
April 18, 2024

Strange but true: Man jump inside well as children no gree him slaughter their mama.

0

Wetin Musa no go see for gate.wahala!!!

One 42 year old man wey hin name be Awelewa don cheat death as he jump inside well but people wey dey nearby rescue him. Wetin really happen?

According to people wey the matter happen for their korokoro eye, dem talk say the man be wan slaughter his wife wey don born four children for am on to say the woman no gree borrow him money again. Out of vexation, he komot cutlass for middle of the night to kill this woman (wife) naso the children raise alarm as neighbor sharperly enter to rescue the woman but he don cut the woman deep for neck.

Wizkid don stir reactions as hin unfollows Tems, Ayra Starr, Osas Ighodaro, others

As he see say water don pass garri, na so he ran komot for house thinking say the woman don die but the neighbor rush the woman go hospital where doctor help save the woman life. Later when news reach him say the woman never die, na so he show face for the compound again. But as he see say his in-law don report the matter give police na so the man ran jump inside well wey dey the compound but neighbors wey see say the man just wan put wahala for their neck no gree him kill himself  as dem gather rescue him

You go like read full tori, abeg click here to read the full gist …I dey here

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *