fbpx
May 5, 2024

2023 WWC: Super Falcons don fly go Melbourne for training tour

super-falcons-don-go-melbourne

Nigeria Super Falcons don fly comot for di Kontri on Sunday go Melbourne night for 15-day training tour ahead of di 2023 FIFA Women World Cup.

Di nine-time African champions go dey for Melbourne and dem go engage in friendly games to fine-tune strategies ahead of di quadrennial competition.

Also, di Super Falcons dey drawn for Group B with co-hosts Australia, Canada and Republic of Ireland.

Randy Waldrum first game of di competition dey against Olympic champions, Canada on July 21 for Melbourne.

 

FOR MORE NEWS: Partner Tinubu for national development – APC tell NASS

 

Di West Africans next two group games against Australia and Republic of Ireland go take place for Brisbane.

Also, di Super Falcons don attend all di editions of di FIFA Women World Cup since 1991.

Dem make am to di quarter-finals for 1999 for di United States of America.

You fit go read di tori see more gist as Super Falcons don go Melbourne for training tour…READ MORE