fbpx
April 20, 2024

Taraba Assembly workers don start indefinite strike

0
Taraba-house-of-Assembly-on-strike

Taraba State House of Assembly workers, under di support of di Parliamentary Staff Association of Nigeria (PASAN) don start indefinite strike because  of di outfit allowance wey di State government neva pay.

PASAN announce di strike notice on Monday through di statement wey State chairman, Ibrahim Bala Yusuf and di Secretary, Abdullahi Abubakar sign together.

Dem no happy upon say di association  don try plenty times to engage di government for roundtable dialogue, di government, under di leadership of Governor Darius Dickson Ishaku, still dey do like say hin no hear wetin dem talk.

YOU GO LIKE READ: Online Marketing Guides for Pharmacists

Dem talk dem no go allow any staff enter di premises of di State House of Assembly, and dem vow say dem no go suspend di strike until dia demands don dey addressed.

As dem don declare di strike, di State government plan to present di 2023 budget this week fit no happen again.

Na inside DailyPost this tori dey, you fit go read di remaining…READ MORE

For more news: I no be Ayade boy – Cross River lawmaker

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *