fbpx
December 22, 2024

Netizens don drag Tems over ‘view blocking’ outfit wey she wear go 2023 Oscars Award

tems-view-blocking-outfit-wahala

Popular singer and Grammy Award winner, Temilade Openiyi wey dey known as Tems don collect plenty tok from netizens because of di outfit wey she wear go di 2023 Oscars.

Di female singer enter di event with regal white outfit wey turn di heads of attendees.

Tems dey nominated for di 2023 Oscars for di Best Original Song category for her collaboration on di song, “Lift Me Up” with popular singer, Rihanna.

FOR MORE NEWS: Lady block man wey ask her make she cook ogbono for talking stage

 

However, Tems outfit don spark reactions online from netizens wey conclude say her outfit for di Oscars no allow other pipo see better view of di stage.

Inside di comment sections, some netizens react to di cloth wey she wear, see di reaction below;

One netizen write: “The dress was gorgeous on the red carpet, but this is beyond rude once seated. Her stylist should have had another dress for her to change into before she was seated. Celebrities do that all the time at events.”

Another tweeted: “So no one asked her to take it off or move? Obnoxious”

You fit go see di full tori and reaction from netizens about Tems cloth…READ MORE