fbpx
May 6, 2024

Uncertainties as Buhari govt Monetary Policies fail to tackle rising inflation

Di-three-months-of-rising-inflation-dey-frustrate-Nigerians

Di three months of rising inflation for 2023, with di recent figure wey stand for 22.04 per cent, don put pain, frustration and agony for di faces of Nigerians and di Kontri economy.

Reports yarn say, as person wey dey drown, Nigerians dey overpowered by di rising food prices and di cost of goods and services. Also, pipo don accept di reality say no time wey person go move body go market wey di prices of goods and services no go increase pass as e dey before.

 

FOR MORE NEWS: Anambra governor gift quintuplets’ mother N2M

 

Di prices of foods, goods and services dey jump, e dey increase without di consideration of Nigerians purchasing power. In addition, di implication be say more Nigerians go enter di land of poverty because dia ability to access basic needs dey shrinks due to declining purchasing power.

According to di National Bureau of Statistics’ March Inflation report, di Kontri inflation increase by 6.12 from 15.92 per cent in 2022 despite di government effort to tackle di trend.

Also, di time when President Muhammadu Buhari dey elected into Office in 2015, Nigeria inflation stand for 9.01 per cent, representing a 13.03 per cent increase compared to today’s 22.04 per cent.

This one mean say di prices of goods and services don increase more than 160 per cent over di eight years of Buhari administration.

Mr Michael Abdul, one teacher for di Federal Capital Territory, yarn say e dey most painful say salaries still be di sam upon di rising inflation.

You fit go read di tori of di three months of rising inflation…READ MORE