fbpx
May 6, 2024

Fuel subsidy: Controversy over $800m World Bank loan to Nigeria

fuel-subsidy-effect-and-World-Bank-loan-anxiety

Nigeria economy be like confused person for some time now and pipo dey worry dey over di World Bank $800 million loan to di Kontri as a palliative to reduce di effect of di proposed fuel subsidy removal by June.

Muhammadu Buhari government don tok am plenty times say hin intention na to stop fuel subsidies before di inauguration of the incoming administration on 29th May, 2023.

As di clock dey tick, debates on di implications of subsidy removal don increase.

Labour, Trade unions and some oil and gas industry experts no hide dia disapproval of di fuel subsidy removal because e go wound Nigerians by shooting up inflation.

FOR MORE NEWS: Yul Edochie don delete all di photos of hin second wife, Judy Austin and dia son

Indeed, for di incoming government, fuel subsidies sustenance or removal na hard nut to crack.

But, after last week Federal Executive Council meeting, di Minister of Finance, Budget and National Planning, Mrs Zainab Ahmed, yarn say Nigeria secure $800 million from di Washington-based World Bank to serve post-subsidy removal palliatives for di Nigerians.

Also, di Minister yarn say di post-subsidy palliative plans go dey distributed to 50 million Nigerians representing 10 million households.

You fit go read di tori of di fuel subsidy and World Bank loan…READ MORE