fbpx
May 5, 2024

Oshodi-Apapa: You no fit evict us, truck drivers, touts dare Sanwo-Olu

truck-drivers-dare-sanwo-olu

LAGOS— Despite di ultimatum wey Governor Babajide Sanwo-Olu of Lagos State give to order sanity along di Oshodi-Apapa Expressway, truck drivers and touts, yesterday, dare di governor Sanwo-Olu say make hin try evict dem.

You fit remember say di Governor Sanwo-Olu, last Friday, bin carry out an inspection tour of di area with ultimatum wey tok say make truckers comot for di road or face dem go face di consequences.

Despite di partial compliance on Monday, di traffic situation don turn to another thing as touts don go back to di Mile-2 axis unchallenged by di Police and Lagos State Traffic Management Authority, LASTMA.

 

FOR MORE NEWS: Eid-el Maulud: PDP call for prayers for Nigeria

 

Di Truck drivers dare Sanwo-Olu, wey claim say dem don settled di pipo wey dey involved in di traffic management along di route, dey dare di Lagos State government to address di problem by tackling the root cause and other contributory factors, also, dem add say truck drivers na human beings too.

Some of di drivers, wey tok dia mind yarn say di road don become dia last bus stop as di government no gree provide dem with rightful place to park.

You fit go read di tori…READ MORE