fbpx
May 18, 2024

Why we hate our Papa– Uche Edochie

why-we-hate-our-papa-Uche-Edochie-don-tok

As veteran Nollywood actor and producer Pete Edochie celebrate hin 76th birthday anniversary on Tuesday, one of hin sons, Uche Edochie, don reveal why dem hate dia papa as dem dey grow up.

On top hin verified Instagram page, inside post to celebrate di birthday anniversary of hin father, Uche yarn say dem mistakenly hate dia papa strict and firm lifestyle, wey hin tok say e dey aimed to add value to dia lives.

Also, as hin describe hin papa as strict man wey ensure hin children success, Uche ask say weda e no dey funny how dem feel di exact opposite way when dem dey growing up?

In addition, Uche Edochie yarn say that time, dem hate dia papa because hin no fit allow dem endanger dia careers and lives in di name of having fun.

FOR MORE NEWS: Nollywood na danger zone for young girls – Regina Daniel reveals

According to am, hin think say those things na problem, and dem grow up to realize say na dem dia self be di problem.

For inside di post, hin thank hin papa for dat lifestyle. Also, hin tok say hin dey glad say hin grow up for 70s and 80s and hin get solid papa to raise am.

Finally, hin wish hin papa wey turn 76 a very happy birthday.

You fit go read di full tori…READ MORE