fbpx
April 19, 2024

UK no dey against Travel to FCT, but dem Insists say di risk still dey.

0
United-Kingdom-UK-advise-dia-citizens

Di United Kingdom UK, don talk say dem no advise against all but important travel to di Federal Capital Territory (FCT) and di city centre Abuja, but insist say di risks still dey present.

E never too tey wey UK warn dia citizens make dem no travel go di capital of di nation, Abuja, because of di increased terror alert for di seat of power.

Di United States government authorize di departure of dia diplomats and family members and some employees of dia embassy for Abuja, because of risk of terrorist attacks by Islamic State of West Africa Province (ISWAP) and Boko Haram terror groups.

YOU GO LIKE READ: 11 Home Safety Tips to Keep Your Family Safe

But di UK government, through di Foreign, Commonwealth and Development Office (FCDO), yesterday, for inside travel advisory for dia website, yarn say no close attack dey for di nation capital, but risk still dey.

Dem still advise against all travel to Borno, Yobe, Adamawa, Gombe, Kaduna, Katsina, Zamfara States and riverine areas of Delta, Bayelsa, Rivers, Akwa Ibom and Cross River States.

This tori dey for inside ThisDayLive, you fit go read I remaining tori there…READ MORE

For more news: Osinbajo go talk for Nigerian investors conference

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *