fbpx
May 4, 2024

UNIBEN condemn killing of student

uniben-condemn-killing-of-student

Di management of di University of Benin UNIBEN, Edo State don condemn di killing of one Desmond, a final year student of di school, wey dey known as Mayor.

According to di tori, dem shoot Mayor, a student of di Department of Public Administration, for face at close range around 9pm.

Also, hin be di the Kegite chief of di school.

Di Public Relations Officer of UNIBEN, Dr Benedicta Ehanire, inside statement on Tuesday, reveal say di management dey work closely with police and internal security to arrest di killer.

FOR MORE NEWS: Sabinus don bag international award

Na wetin di statement read be dis, “The management of the University of Benin has condemned the brutal and sad killing of a final year male student, known mostly as ‘Mayor’ (real name withheld) on the night of Monday 3rd March, 2023.

Di shooting happen for inside one of di halls of residence and na some unknown identified gunman na hin do am.

As di school dey morn with di family and colleagues of the late student, di management advise other students say make dem stay calm.

UNIBEN condemn killing of student, You fit go read di tori…READ MORE