fbpx
May 9, 2024

Sexual assault : UNICAL don suspend Law dean, Prof Cyril Ndifon

unical-suspend-law-dean

Di University of Calabar, UNICAL don suspend di dean of di Faculty of Law, Prof Cyril Ndifon over di claim of sexual harassment of female students.

Hin suspension dey inside letter wey dem carry come out on August 17, 2023, and na di institution registrar, Gabriel Egbe na hin sign di letter.

Di letter yarn say UNICAL don suspend Law dean Ndifon for violation of di provisions of di extant laws and policies of di institution.

In 2015, police bin arrest Ndifon and dem detain am, also, di university suspend am over di same accusations of sexually assaulting female students.

Also, e no too tey wey female law students carry placards and all of dem come out protest for campus, dey call for hin removal.

 

FOR MORE NEWS: Man break up with girlfriend because she dey too independent and hin no fit control her

 

 Some of di placards get inscriptions like, Ndifon must go!” “We’re tired of sucking dicks for marks”, “Law girls are not bonanza,” and “Prof Ndifon must stop grabbing our bum bums.”

 According to di letter, di suspension come on di heels of Ndifon response to query wey di University management give am.

According to di report, di Vice Chancellor bin no dey dissatisfied with Prof. Ndifon’s response to di query wey hin give am.

And because of dat, di VC give order say make dem suspend Ndifon from hin position as Dean.

 Di authorities carry di matter go meet panel wey go investigate di allegations wey dem level against am.

You fit go read di tori…READ MORE