fbpx
December 21, 2024

UNILAG debunk claim of additional tuition fees increase

unilag-debunk-clain-of-tuition-fees-increase

Di University of Lagos, UNILAG don debunk di claim wey tok say di institution don add extra charges to dia earlier increase tuition fees.

You go fit remember say di institution in July, bin increase dia fees from N19,000 to N190,250 for students wey dey studying medicine and N140,250 for students wey dia course go need laboratory and studio use.

Inside press statement wey come out on Friday, di Head of di communication Unit, Adejoke Alaga-Ibraheem, explain say di information wey dey make rounds say di University don add additional unauthorised charges to dia earlier increments no be true and na pipo dey share am to misinform di public.

Alaga-Ibraheeem add say di institution no give any other notice of increment apart from di “Adjusted Obligatory Fees” for New and Returning Undergraduate Students.

 

FOR MORE NEWS: Kebbi Gov Swears In 26 Commissioners

 

The statement read, “The University of Lagos wishes to explicitly refute unsubstantiated claims making the rounds that the University has “slammed additional unauthorised charges to its earlier increments.”

“These completely untrue and misleading claims misrepresent the facts and aim to misinform the public into believing that there has been another adjustment of fees.

Also, she tell students and parents make dem disregard di information, and she add say di management understands di economic situation of di nation.

Later, she still tok say make di public to avoid dat kain misleading reports but rely on di university official communication channels for announcements, updates regarding fees, and others.

You fit go read di tori wetin dem tok as UNILAG debunk claim of tuition fees increase…READ MORE