fbpx
May 18, 2024

Union Bank wan reward dia customers with N50 million

union-bank-wan-reward-customers-N50m

Union Bank of Nigeria Plc don yarn say dem go reward customers with N50 million for dia  Save & Win Palli Promo.

Di grand finale event, wey go hold on January 27, 2023 for Lagos, go reward over 300 lucky customers with cash prizes worth over N40 million and other exciting consolation prizes.

Union Bank said yarn say one lucky customer go return house with di grand prize of N5 million from di Save and Win promo draw, while other customers go receive other cash prizes of N105,000 and N500,000 for di last set of di monthly and quarterly draw winners.

“Union Bank go also reward 227 customers with N18.5 million for dia other ongoing savings promo called UnionKorrect.”

FOR MORE NEWS: NASS and CBN dey drag over old naira notes deadline

Dem add say di UnionKorrect regular and exclusive draws go run alongside di Save and Win Palli Promo draw for di same day.

Di event go dey  live-streamed, and participants fit join online from anywhere for di country. Dem go select Winners  randomly  through electronically generated and transparent draws. This activity go dey monitored by relevant regulatory bodies.

Above all, di Save & Win Palli Promo and UnionKorrect promo na nationwide campaigns. E dey aimed to reward customers with cash prizes and other exciting gifts. Di goal na to encourage and promote a healthy savings culture.

You fit go read di full tori…READ MORE