fbpx
April 24, 2024

Universities fit lose session as ASUU strike still continue.

0
Emmanuel-Osodeke.-Admission

As e be like say di strike no go end like this, Academic Staff Union of Universities (ASUU), seven months after, di fate of students wey dey find admission go one of di nation universities still dey unknown as two new sets still dey wait for di resumption of academic activities.

Di first set of students, wey complete their admission process last year, still never fit resume, while another group of students don sit down for di Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) this year.

YOU FIT LIKE READ: Na why we drag ASUU go court over di strike be this. – FG

Di way wey things dey go so, two sets of new students, 2021 and 2022 dey wait to resume.

One lecturer for di University of Lagos (UNILAG) wwey tok with The Guardian say plenty universities get two sets of students wey dey ready to resume di academic session.

Di ones wey dem admit for 2021 suppose don resume after di second-semester examination early this year but dem no resume because of strike. Now, another set of students don write UTME this year, dey wait for admission process.
You fit CLICK HERE go read di full tori for THE GUARDIAN

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *