fbpx
March 28, 2024

US Court to Sentence Hushpuppi on September 21

0
Hushpuppi\in jail\

US Court to Sentence Hushpuppi on September 21

|The United States Attorney’s Office for Central District of California, Los Angeles don talk say dem go sentence Nigerian-born Ramon Abbas, also known as Hushpuppi, for the claimed international Internet fraud, for September 21, 2022.

Dem suppose don sentence am but dey rescheduled two times, from February 14 to July 11.  Now the court don confirm say e go take place on September 21.

Na the matter be this now.

If he dey guilty for the matter of fraud, Abbas go face legal maximum sentence of 20 years for federal prison.

One statement wey show for July 2020 by the Department of Justice, U.S. Attorney’s Office, Central District of California titled “Nigerian National Brought to U.S. to Face Charges of Conspiring to Launder Hundreds of Millions of Dollars from Cybercrime Schemes”, talk say Abbas, a Dubai resident wey bin dey flaunt how e take dey squander money for social media land for the United States to face criminal charges as dem talk say he follow plan to launder hundreds of millions of dollars from business email compromise (BEC) frauds and other scams, wey include schemes wey target U.S. law firm, a foreign bank and one English Premier League soccer club.

 

You fit also enjoy this one: Money ritual still dey town, make una stop to dey run after man money. – Actress Sonia

The statement talk say Abbas, 37, a.k.a. “Ray Hushpuppi” and “Hush,” Nigerian national, land for Chicago after United Arab Emirates (UAE) law enforcement officials arrest am, dem kon comot am from that country. The first place wey he appear na U.S. court for Chicago later dem send am go Los Angeles.

The FBI special agents gain the custody of Abbas, dem kon carry am go United States so that he go face charge for planning to dey follow do money laundering wey dem accuse am of for criminal complaint. Na the federal prosecutors for Los Angeles file the case.

To find out more of wetin dey happen inside the tori, CLICK HERE.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *