fbpx
May 18, 2024

Victor Moses pray for Turkish earthquake victims

victor-pray-for-turkish-earthquake-victims

Thousands of people don kpai and di toll dey expected to rise with plenty pipo wey still dey buried under di destroyed buildings. Victor Moses don pray for Turkish earthquake victims to show say hin care about them.

Several Nigeria internationals including Ahmed Musa, Bright Osayi-Samuel, Chuks Akabueze, Aaron Samuel, Henry Onyekuru, Aminu Umar and Olarenwaju Kayode bin play for Turkish clubs.

Inside press release on Monday, di Nigerian Football Federation express sadness about di unfortunate earthquake for Kahramanmaras city of Turkey and dem confirm say all di Nigerian players wey dey live for Turkey dey fine.

FOR MORE NEWS: Serie A: Osimhen dey happy as hin make history with Napoli

Moses get soft spot for Turkey, as hin don represent Fenerbahce before for one year, on loan from Premier League side Chelsea.

Also, di 32-year-old express hin solidarity with di Turkish pipo and every other person wey dey affected by di earthquake. Victor pray for di Turkish earthquake victims and hin use  red heart emojis, as sign to show say hin care.

Moses, wey dey close to returning to action after several months for sidelines due to injury, bin score five goals for 23 appearances for Fenerbahce.

You fit go read more of di tori…READ MORE