WAEC don arrest principals, supervisors, for malpractice
WAEC don arrest atleast 20 officials wey allegedly help with examination malpractice for di ongoing West African Senior School Certificate Examination, WASSCE, for school candidates.
Di Council yarn say di arrests happen for different parts of di country.
In addition, di Head of National Office (HNO) of Council, Mr Patrick Areghan reveal di tori ton di sidelines of monitoring exercise wey hin carry out for some schools on Thursday for Lagos.
According to am, di WAEC don hand over all the culprits to police for prosecution.
Areghan vow say di Council go do everything possible to make sure say dia prosecution follow logical conclusion.
Also, Areghan describe di act as monumental disgrace.
FOR MORE NEWS: “Why I disappear from Nollywood” – Actor, Nonso Diobi don open up
Di WAEC official yarn say di proprietor and supervisor dey for police custody now.
Hin yar say di same situation happen for Osogbo, where one principal, invigilator and chief supervisor dey under arrest for di same offence.
According to am, for Kaduna, too, one supervisor and examination official na hin dem catch red-handed.
As WAEC don arrest officials, Areghan yarn say di arrest go continue until di end of di examination.
You fit go read di tori…READ MORE