fbpx
May 9, 2024

Commotion as police tear gas for protesting UNILAG students

police-tear-gas-for-unilag-students

Commotion full everywhere on Wednesday after officers of di Nigerian Police Force fire tear gas for students of di University of Lagos UNILAG.

Di students bin gather around di school to protest di increase for school fees before di Police tear gas for di UNILAG students.

According to how everything bin dey go, di protest appear peaceful until police officers wey dey on ground to monitor di students fire gunshots.

Di National Association of Nigerian Students on Tuesday warn di Department of State Services make dem no stop di students from exercising dia rights to protest. Dem tok say na universally recognised human right.

 

FOR MORE NEWS: “I go like work with Kanye West” – Asake

 

Also, di National Public Relations Officer of di union, Giwa Temitope tok for inside statement. Hin yarn say di by di DSS on Monday wey tok say some politicians dey mobilise student leaders for violent protest against di Federal Government over socioeconomic matters na propaganda.

Also, hin boast say di protest go still go on as dem plan am.

You fit go read di tori…READ MORE