fbpx
April 23, 2024

Wizkid bodyguard claim say person thief hin phone for Lagos club

0
Roy.png

Wizkid bodyguard Roy Emmanuel don cry out after person thief hin phone for di popular Quilox Club inside Victoria Island, Lagos.

For hin Instagram story on Monday, Roytok say hin leave hin phone on top of one car for di Quilox car park on Friday, and one lady carry am.

He share CCTV footage wey show one lady wey carry the phone from wey dey on top car.  Di thing wey hin need now na Informations about di lady.

YOU FIT LIKE READ: I dey safe, comedian Sabinus survive serious crash.

He announce say di phone wey dey thief na iPhone, Roy promise to keep the lady identity private after he recover di phone.

Wizkid bodyguard don even promise reward for anybody wey go give am better information.

Famous Poco Lee follow React to di wahala, hin tok say, why di lady for carry di phone comot.

Hin say,  she for just ask for di owner or drop am with one of di workers for di club.

You fit CLICK HERE go read more of di tori.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *