fbpx
April 26, 2024

Yemi Osinbajo reach Nairobi for Ruto inauguration

0
Osinbajo-in-Nairobi-

Vice-President Yemi Osinbajo don reach Nairobi, to represent Nigeria for di Kenyan presidential inauguration.

Di event, wey go start on Tuesday for Kasarani Stadium, Nairobi, go be Kenya fifth presidential inauguration.

Yemi Osinbajo for di Jomo Kenyatta International Airport, Nairobi, dey welcomed by former Governor of Kwale County, Salim Mvurya, Nigerian Ambassador to Kenya, Yusuf Yumusa and other senior government officials.

Di vice-president dey accompanied for di trip by di Minister of State for Foreign Affairs, Amb. Zubairu Dada and di Special Adviser to di President on Political Matters, Sen. Babafemi Ojudu.

YOU FIT LIKE READ: 2023: Kwankwaso don clear di air about hin stepping down for another presidential candidate

On Aug. 15, dem announce Deputy President, William Ruto as di winner of Kenya presidential election wey don do on Aug. 9.

Independent Electoral and Boundaries Commission (IEBC) Chairman, Wafula Chebukati, yarn say Ruto don win almost 7.18 million votes or 50.49 percent, against 6.94 million or 48.85 percent, of hin rival, Raila Odinga.

Kenya’s Supreme Court, on Sept. 5, follow support Rutho electoral victory.

You fit CLICK HERE read more of the tori.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *