fbpx
April 26, 2024

Jalingo students dey protest

Jalingo-students-dey-protest

Economic activities dey on hold for Jalingo since Monday, Taraba State as Jalingo students dey protest over lack of attention by di government.

Di Taraba State University, TSU students wey supposed start dia first-semester examination yarn ay dem no happy over di failure of di government to address di difficulties of lecturers.

The students who took over the state capital in a rally called for the impeachment of the state governor, Arc. Darius Dickson Ishaku.

Armed security operatives na hin dem send full di city, as Jalingo students dey protest, dem go di government House, tear all di posters and billboards wey carrying di logo of di Peoples Democratic Party (PDP).

FOR MORE NEWS: Herbalist give customer belle for Kano

Students burn tire for major roads of di Jalingo metropolis, that one kon cause serious traffic gridlock, vehicles  sef no fit move.

This matter follow make pipo dey fer say make hoodlums no kon hijack dem. Shops and store owners for di major road close dia businesses as di protest continue.

Some students yarn say dem go continue to protest until di state government address di difficulties of di lecturers.

You go like read di full tori… READ MORE