fbpx
April 24, 2024

50 Cent wan shoot tv series about Hushpuppi

0
50-Cent-Hushpuppi-

Rapper, movies and TV shows producer, Curtis James Jackson III wey pipo know as 50 Cent don announce plans to do tv series bout di story of internet scammer, Ramon Abbas – Hushpuppi wey US police don convict.

Jackson wey dey famed as person wey dey produce hit tv series like Power, Power Book II, Power Book III: Raising Kanan, amongst others, make this announcement for hin Instagram page on Wednesday night, hin write: “For my scammers I gotta do this one, Hushpuppy series coming soon ! GLG🚦GreenLightGang I don’t miss 🎯

YOU GO LIKE READ: 9 Tips to Stay Productive at All Times

E neva too tey wey dem give Hushpuppi 11 years and three months’ jail term, that one mean say hin go dey locked up for nine more years after hin don spend two years behind bars already.

Meanwhile, Nigerians wey dey follow 50 Cent don express mixed feelings about di development.

Nollywood actress, Uche Jombo follow beg 50 Cent say make hin allow Nigerian actor get di opportunity to play di character.

This tori dey inside vanguard, you fit go read di remaining…READ MORE

For more news: US Court don carry Hushpuppi put for jail

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *