fbpx
April 30, 2024

Market leaders warn Lagos traders against fixing random prices

market-leaders-warn-lagos-traders

Market leaders for Lagos don warn traders’ associations make dem stop to dey impose uniform prices on dia goods and other exploitative practices.

Also, as Some Market leaders warn Lagos traders, inside separate interviews, dem respond to complaints. Dem yarn say traders’ associations dey fix random prices for dia goods.  And dis style na to rip off di pipo wey go patronise dem.

Rukayat Ailero, di Iyaloja of a community market for di Ayobo area of di state, yarn say traders’ associations na to protect members’ interests. And she yarn say no be to exploit dia customers.

FOR MORE NEWS: Nnewi prodigal brother – Peter Obi don reveal who leak hin conversation with Oyedepo

Even as she describe di ransom fixing of prices as dishonest, Ms Ailero yarn say any association wey force dia members to sell at certain prices for di market go dey sanctioned.

Also, she yarn say e dey wrong to say make pipo sell at certain prices. Most times, dem dey do am to get profit. However, she yarn say make everybody dey allowed to decide di price wey dem wan to sell dia goods. In addition, di price need to dey fair.

She yarn say any association wey dem catch dey do dat kain thing go dey sanctioned and reported to di appropriate authorities.”

You fit go read di tori…READ MORE