fbpx
April 27, 2024

Amapiano artist, DJ Sumbody don kpai

0

Popular south African DJ and Amapiano artist, Oupa John Sefoka, wen many pipol know as ‘DJ Sumbody’, don die for Johannesburg in di early hour of Sunday morning.

Sumsounds Music yarn di death of di amapiano pioneer to tori pipol on Sunday morning, according to News24.

U FIT ALSO READ Singer Portable sacks all his studio staff for making only N7k in a month

According to tori DJ Sumbody bin dey travel on Woodmead road for south Africa as some unknown gunmen attack am for road spray hin car with bullets of gun and dem kill one of him bodyguard too.

Like dis like dis report tok say investigation dey go on.as dey wan know wetin really cause di attack.

Di Amapiano pioneer na di brain behind di show Mashaedi on the Engage wen dem dey broadcast on Tshwane.

For 2018, Oupa John Sefoka aka Dj Sumbody drop hin song title “Monate Mpolaye” and di song bin go viral con gain prominence for national level.

Hin don also release plenti plenti songs and albums wen don attract positive feedback,and contribute more success to hin musical career

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *