fbpx
April 19, 2024

DJ Cuppy don engage British boxer

0
Cuppy-and-Tylor-

Famous Nigerian disc jockey and producer, Florence Ifeoluwa Otedola, wey dey popularly known as DJ Cuppy, dey engage to her British boyfriend and professional boxer, Ryan Taylor.

Taylor engage Cuppy on stage for Gumball award night for Abu Dhabi on Saturday.

For inside trending video wey dem share for Instagram, dem see di billionaire daughter for di presence of her best friends as her lover propose to her.

YOU GO LIKE READ: 5 Effective Travel Agency Online Marketing Tips

Di 30-year-old British boxer share passionate kiss with Cuppy on stage to the thrill of di attendance while Bruno Mars’ ‘Marry You’ play for di background.

A few months ago, Cuppy claim say e dey difficult for her to find man wey go love rather than to dey with her because of her billionaire papa.

This news dey inside DailyPost, go READ MORE

For more news: Covenant University don win best private university award

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *