fbpx
April 23, 2024

ASUU don condemn di introduction of student loan bill

0
ASUU-President-Professor-Emmanuel-Osodeke-student-loan

Di Academic Staff Union of Universities (ASUU) don accuse di Nigerian government of say dem wan attempt to ‘systematically’ wash dia hand comot for di funding of public universities with di introduction of student loan bill by di National Assembly.

Di chambers of di National Assembly don pass student loan bill wey dem first introduce to di house by di Speaker of di House of Representatives, Femi Gbajabiamila, for 2016.

If e don dey approved by President Muhammadu Buhari, di government go dey mandated to establish education bank to provide education loans for students.

YOU GO LIKE READ: 9 Tips to Stay Productive at All Times

But ASUU, for di statement by dia President, Emmanuel Osodeke, a Professor of Soil Science, condemn di move. Hin describe am as an attempt to make university education beyond di reach of poor Nigerians.

For di statement wey dem release after di quarterly National Executive Council (NEC) meeting for di University of Calabar, ASUU claim say di education loan wey dem proposed don fail for di other countries where dem introduce am.

This tori dey inside Premiumtime…READ MORE

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *