fbpx
April 27, 2024

Death of Davido’s son: Entertainers yarn say dem get swimming pool inside house.

0
Davido-indoor-swimming-pool

Some Pipo dey vex, other pipo dey  worry and dem dey sad about di sudden death of Davido son, Ifeanyi, reach di public space like thunderbolt.

Dem report say di three-year-old toddler drown inside swimming pool wey dey di singer Banana Island residence on Monday, October 31, 2022.

Ifeanyi death happen exactly three years after another superstar, D’banj, lose hin one-year-old son, Daniel jnr for di same situation. Di singer bin dey for Los Angeles, di United States, for di BET Awards when di sad incident happen.

YOU GO LIKE READ: 11 Home Safety Tips to Keep Your Family Safe

Na di same way, Davido and hin baby mama talk sat dem travelled go Ibadan for family gathering when di unfortunate incident happen.

According to report, dem ask different entertainers about dia opinion for person to get swimming pool inside house. Most of them yarn say dem get but e dey better to put barrier around am so that e no go endanger di lives of children and other pipo around.

For more News: Fire catch NYSC headquarter for Abuja

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *