Di revelation enter light for “di, frankly speaking, podcast” with media personality, Nedu. As she dey talk about her experience, dem ask Blessing where she do her surgery.

Di mother-of 2 share say she do her surgery for di Lekki area of Lagos State. She still mention say she spend over N3 millionto take get her new body.

YOU GO LIKE READ: How to Educate Yourself on a New Subject

Some tori bin talk say Blessing Ceo document her procedure for her fans make dem journey with her. But she reveal via di podcast say she suspect some people wey she meet for di hospital fit leak her videos before her.

Na that reason na hin make her decide to document di process herself.