fbpx
April 25, 2024

JAMB Don Discover High Forgery Of A’Level Results

jamb-don-discover-high-forgery

Di registrar of JAMB yarn say dem don discover high level of forgery of A Level certificates wey pipo dey use for di registration. And because of dat development, di Board don introduce new guidelines to checkmate such act.

Also, di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don resume di 2023 Direct Entry (DE) registration exercise.

Registrar of JAMB, Professor Is-haq Oloyede, wey drop di update during briefing on Monday for Abuja, yarn say di DE registration go close on 28th April, 2023.

He yarn say di Board start di 2023 Direct Entry registration on Monday, 20th February, 2023, but dem immediately suspend am as JAMB Discover High Forgery of di standard A ‘level qualifications wey dey required from DE candidates.”

FOR MORE NEWS: “I don’t regret running for office” – Funke Akindele don break silence on election loss

According to am, di Board, concerned stakeholders and institutions dey working hard to detect such acts and di ones wey dem don see don already dey dealt with according to di provisions of di law.

He yarn say to further checkmate di anomaly and to also prevent recurrence of such irregularity, di Board don decid say di 2023 DE registrations no go only dey restricted to JAMB Professional Test Centres (PTCs) but e go dey done under strict supervision.

You fit go read di tori…READ MORE