fbpx
May 18, 2024

JAMB don adopt 140, 100 as minimum score for universities, poly, colleges of education

jamb-minimum-score-for-admission

Di Joint Admissions and Matriculation Board JAMB, don adopt di National Minimum Tolerable score for admission into universities, polytechnics, and colleges of education as 140, 100 and 100 respectively.

Na di JAMB Registrar, Prof. Ishaq Oloyede, reveal dis tori for di 2023 Policy Meeting of Tertiary Institutions for Abuja on Saturday.

Also, hin yarn say all institutions must abide by dis rule and dem must not go below di approved points.
Hin follow tok say every tertiary institution must ensure dia own minimum standard, especially as e relate to institutional screening and grading for di Senior Secondary Certificate Examination (SSCE), wey must not dey lower than 50 marks.

 

FOR MORE NEWS: Presidential Poll Dispute: Atiku don closes case against Tinubu with 27 witnesses

 

Also, dem yarn say all institutions must abide by di minimum point. And dat one mean say no institution fit go below di standard.
In addition, dem tell di 15 private universities wey demand between 120 and 130 as minimum points, say make dem violate di 140 standard.

Dem tok say na because di system put in place no go recognise 139, so dem need to make sure say dem comply.

Oloyede yarn say institutions must not collect more than N2,000 as screening fees from candidates.

You fit go read di tori of JAMB Minimum score for admission…READ MORE