fbpx
May 9, 2024

Lecturer use fingerprint scanner take class attendance

lecturer-with-fingerprint-scanner

One lecturer don go extra mile to take class attendance with fingerprint scanner so dat students no go write di names of absentees.

Di lecturer at di University of Port Harcourt, UNIPORT, don collect praises because hin use fingerprint scanner to track student attendance after di video go viral.

Na di fingerprint machine di lecturer use take accurate records of all di students wey dey hin class to prevent petty fraud.

Di video show as di Lecturer dey stroll around di classroom dey give di students di scanners make dem for do dia fingerprint.

 

FOR MORE NEWS: Nigerian rapper, CDQ dey wheelchair after life-threatening accident

 

Plenty pipo wey see di video yarn say di lecturer do di right thing because some students dey always get mind write di names of dia absent friends for di class registration.

Others, believe say some pupils go discover method to work around di lecturer novel notion.

You fit go read di tori…READ MORE