fbpx
April 20, 2024

Mabo Foundation tackle health, education mata inside Niger Delta

0

Di Roli Mabo Foundation don donate one health facility, with medical supplies and two permanent nurses, to Jakpa Community for inside Warri North Local Government Area of Delta State.

Di foundation also donate educational materials such as books, bags, uniforms, shoes and other learning items to pupils in di community.

U FIT ALSO READ Nigeria needs new funding model for tertiary education – TETFund

During di inauguration of di health facility and handing over of di educational materials to di community,

Roli Mabo Foundation’s team led bi Ade Mabo, tok say di mission of dia organisation na to ensure good health care and educational development for communities wey dey for Niger Delta environments.

Hin con still tok say “ dia mission na to help solve two problems Niger Delta,

Firstly na to ensure say all children for di region bin dey educated by establishing schools.for di communities and moreso. to re-enforce existing schools, build libraries and ensure say di children get everything wey dem need to study.

Dia foundation don readi to empower teachers with incentives wey go make everything dey affordable for dem to go and teach di students.

Secondly dia mission na to provide healthcare services like establishing clinics with nurses to treat di children, di elderly, women and di entire communities for areas where dem establish beta school systems.

Those clinics dey 100 per cent free for di community and di foundation dey give dem assurance to continue to fund di drugs, medication and pay all di nurse salary.

Mabo tok say dem don establish school and clinic inside Jakpa with pre-existing structures and now dey wan do di same for communities like Obonteghareda, ijaw/Itsekiri neighboring villages.”

Mabo tok say: “ dey don also set up full sized library with plenti copies of government approved text books for primary 1 to 6 inside di library so dat children go fit get access to standard library to learn for Jakpa Community.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *