Ngige want make Tinubu govt review minimum wage
Di Minister of Labour and Employment, Chris Ngige, don tell di incoming administration of di President-elect, Bola Tinubu, make hin review of di current minimum wage of N30,000 wey dey obtainable for Nigeria now.
Ngige, wey be member of di committee wey negotiate di present minimum wage in 2019 from N18,000 to N30,000, yarn say dem need to review di Kontri minimum wage every five years to fit di current standard of living.
Di minister, wey tok on top Channels Television Politics Today on Wednesday, still mention say hin go include for hin handover notes say di discussion surrounding minimum wage need to start immediately di new government enter office in May 2023, ahead of di implementation, wey hin tok say suppose be in May 2024.
FOR MORE NEWS: Chelsea: I’m not going to achieve my goals – Mason Mount don make honest confession
He yarn say di discussions go involve di public sector, private sector and state governments.
Also, Ngige yarn say di Federal Government don approve a pay rise for civil servants wey go take effect from January 1, 2023. Hin add say di provision dey already included for di 2023 budget.
Di minister yarn say di salary increment dey important in view of di current economic reality of di country. However, hin add say di President, Major General Muhammadu Buhari (retd.), neva approve di percentage wey dem use for di increment.
You fit go read di tori…READ MORE